Addynamo

Funny Post: If you do any of this, Then you're a Winner - Check it Out!!

U dey do opening prayer 4 Night Club.
- Na God go slap ur mouth.
 
U drink garri come say na rice u dey chop
  - Na poverty dey worry u

 U buy blackberry u come talk say u won make am do phone center
    U be mumu 

 U day use Photoshop day form say na there u snap am
    na virus go catch your lie

   U chop slap from one gul finish u come load her phone with credit.
      Make una c maga 

     U no get money 2 buy blackberry and u dey tel people say u no like d phone
         hahahaha na poverty dey nack u akpako

    Dem buy u ice cream for cold weather u dey light stove say u want warm am say e too cold...
         Na mumu go kill u

  U soke garri finish then u put toothpik for mouth......
    na porverty dey worry u

 U enter restaurant and take one pure water with tooth-pick and come out dey bost say u dey pick meat from ur mouth........... na wahala go finish you.

 You use ur last money buy wallet dey talk say u get faith say money go enter the wallet....
  ha ha ha ode hunger go kill u die

  U won go toast woman,u come de folo her 4 back til she rch her house,u com back com tel ur guyz say she luv u die!!!.....bros na lie go strangle u 

U no get money 2buy blackberry con talk sey 2go fit do wetin bb go do.
 na poverty b dat

 U put lacasera 4 glass cup dey form sey na Ace of spade u popping. ...
    na poverty dey envy u.

 U never pass ur weac after writing for 5 times but u dey tell guys for area say u dey write for pple as machinery . Na deceive you dey do ur self

 U buy pure water,put am inside eva bottle water,come dey carry am waka,up and down dey form level.i no go swear 4 u but u know urself

 U dey eat 4 dream hopin say when u wake u go belleful abeg wakeup

U enter 3rd mainland bridge dey tell those engineer say u b omo onile haaa if fashola catch u 

You dey go lecture for 5 years 4 university when dem no admit u, u cum dey xpect bsc
  na ur ancessstors go give u....

U won go commit sucide 4 bush wit rope...u kon see snake 4 tree...u kon run....ahahahahahah o boy u stil lyk ur lyf... 

U dey chop garden egg with butter,u talk say u dey eat balance diet..... na hospital go be ur portion.


U come back from dubai dey form British accent.
- Na rat go chop ur mouth

U be house boy u come dey play Rick Ross - I am the Boss.
-4 where na.....mumu

U dey add water to egg say e go plenty when u fry am.
- Why u no add yeast join am....olodo.

U no go university, and u dey find ur name for NYSC posting.
- Na yeye dey worry u.

House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher
- Hahahahaha....u don die.

U de say Terry G's music dey inspire u
- unto which level!! free madness?

U carry candle dey look for where fuel dey smell from.
-continue u go soon see am

U call MTN to tell dem say your free browsing has stopped working.
- Lolzzzzzzzzz... ..mad man

When pastor talk say 'Do something crazy for the Lord' You come carry church offering run
- na who wan chase u?.....

You Read dis post Smile & You no kon Click on the LIKE or Share button #mtchew#..
- na u stingy Pass.

Don't forget to like, share & drop a comment

No comments:

Post a Comment

I love Comment's so please feel free to drop a comment. Thank You.